Music Video

Credits

PERFORMING ARTISTS
Erigga
Erigga
Vocals
Krista
Krista
Vocals
COMPOSITION & LYRICS
erhiga agariubie
erhiga agariubie
Songwriter
Edema Oritsetimeyin Joelson
Edema Oritsetimeyin Joelson
Lyrics
PRODUCTION & ENGINEERING
Edema Oritsetimeyin Joelson
Edema Oritsetimeyin Joelson
Producer

Lyrics

[Intro]
Abeg
My name na Erigga Paper Boi, mehn
Welcome to family time, you no understand?
Assumption na the mother of mess up
No be story when dem put go farm nai dem dey put when dem dey come back oh
From lost boy to family time
You know who I be?
[Verse 1]
Me I no be that kind human
I no dey force my things
Everyday na cruise and vibes
You know that kind things
Make them carry talk my matter for back
I no fit stress, I no fit worry
Ki lo ko mi
I’m making money
Jah Jah blessings upon me
Abeg abeg
Na God abeg
Enemy sef wan worry their head
But anointing dey for here
E dey my head
I no relent
Na ahead ahead
If the money dey for there
I dey for there
I hear the gist, but, me I no send anything you do for there
I dey for here
Dey chop life, bro, me I no send
[Chorus]
It’s unruly
To assume that
This man gon' fail
Never, never, never
So unruly
To assume that
I'm gon' fail
Never, never
[Verse 2]
They tell me say God dey he church but I no see am for there
I see am for my heart, since then nai two of us dey pair
Your man dey jump, hold am before e disappear
If money no be magician, why her clothes disappear?
I smell good, if no be Burberry na Dior, Dior, Dior
Call your kpọkpọ, we dey your door kpọkpọkpọ
Open, tell me wetin you wan use my downfall do
Human being bad, wetin make you feel say church dey full?
Whooooo, you feel say you fit do like me?
Cool, tell am make e do am like me
The last person when try no reach two minutes
Industry no forget am, na he money finish
For we no to dey flog ground when snake don pass
Go work on yourself, you no fit hate who work pass you
But idle man no go gree, e dey devil workshop
Dey argue, e no fit work, all he tongue dey blue
Stay the fuck away from me if your energy bad
You no be my blood, you no be my squad
You only love me when things dey hard
Wetin dey sup, why na only me dey use my card?
Swipe, I no need canoe soap or sponge
To watch my back na Oluwa work be that
But if na match una want, na to flip the coin
Leave ten for your back like Ronaldo ask
[Chorus]
It's unruly
To assume that
This man gon' fail
Never, never, never
So unruly
To assume that
I'm gon' fail
Never, never
[Verse 3]
Actually, I started my day with dick standing
Small Claro from last night, two outstanding
TV still dey on, enter shower, hit the road
No wan miss my train cos time for London na gold
I get business meeting with some white men
Serious bag when fit make police invite men
So when you see me drive pass you, abeg no vex
I too trek when I broke nai make me buy Benz
The white one
[Outro]
So no go dey assume, you no understand?
Assumption na the mother of fuck up
Family time, the album is here
O ya nah
Written by: Edema Oritsetimeyin Joelson, erhiga agariubie
instagramSharePathic_arrow_out