Top Songs By Erigga
Similar Songs
Credits
PERFORMING ARTISTS
Erigga
Vocals
COMPOSITION & LYRICS
erhiga agariubie
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Obi Promise
Producer
Lyrics
[Intro]
Ah, Paper Boi, how far nah?
You still dey enter that boogie today?
Oh boy, una don come wit all this una Saturday party oh
Me I don tire, I wan relax oh
But my guy na the DJ there nah
You go perform nah, all those your jams nah, I understand nah
Me I get school oh, omoh, I get exam oh but no wahala make we enter nah
E no get how e be, we go rock am
[Chorus]
My saddest days were Saturdays
Audi with my guys, dey observe the place
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes
My saddest days were Saturdays
Beer parlour with my guys, koti come we gbese
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes
[Verse 1]
Normal level, I dey school dey do my bookworm
Class finish, na to find one baby pull on
Bring kala if you move wrong
Touch us, community don remove gun
Leave all these rappers na mouth, dem no get receipt
For all those their war stories, dem just dey find retweet
Their heart dey beat through their shirt when we waka pass
One even piss for trouser as I wan break he teeth
Na mostly on Saturday we dey enter gbege
Or big gbese, nsogbu, e don burst again
Cos who we send go call girl, dem don burst he head
Party don scatter, I dey come, help me hold ma chain
Manager dey beg, aboy, that one no concern me
Scatter rubber chair for him back, stab he bouncer knee
Run enter area, chelle, until the matter die
Before we come out make mouth, you know this matter guy
[Chorus]
My saddest days were Saturdays
Audi with my guys, dey observe the place
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes
My saddest days were Saturdays
Beer parlour with my guys, koti come we gbese
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes
[Verse 2]
Big cutlass for the bush path
Incase e burst, na to know where I go move pass
Yawa go soon gas
3 to 1, we no dey fear to reduce crowd
The small jazz when we do na 6:00 o'clock e dey end
Locate the opt, alert my men
Collect their phone, based on fuck up fee
Follow back run, vigilante wan dey draw pumping
The last person when try am, na gutter we see am
E be like film for e eye, the way koti take play am
This no be story when I suppose dey talk for track
Yokozona, I sit down una face with facts
Na we dey increase the crime rate then
Okere prison still choke with men
Saturday night, I lost my friend
E still dey pain me, I no fit pretend
[Chorus]
My saddest days were Saturdays
Audi with my guys, dey observe the place
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes
My saddest days were Saturdays
Beer parlour with my guys, koti come we gbese
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes
[Outro]
Can't believe how we dey run am that year, mehn
**** go trek go find kele
When we wan go back, we go come dey pray make dem no see as we dey trek dey go house
Until we come gather money, go rent one car
That car nai put us for problem, I swear
Omo, we don really crase for this Wafftown, I swear
Written by: erhiga agariubie