Top Songs By Erigga
Credits
PERFORMING ARTISTS
Erigga
Lead Vocals
COMPOSITION & LYRICS
Erigha Agharivbie
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Critic Jed
Producer
Ayee.PEWRLD
Producer
Lyrics
[Chorus]
Rest in peace to all the friendship wey money spoil
As you dey ur own I dey my own you no get peace of mind?
Two tequila to relationship wey money spoil
As you dey ur own I dey my own I come get peace of mind

[Verse 1]
Some kind times na we dey use our hand find problem
You see friendship when suppose die you go dey give am breath
Because of people ur WhatsApp you hardly go there
Post your enjoyment, shey you dey see yourself?
I pray you heal from the things u no dey talk about
Life hard only you no fit do am alone
Just no involve me cos the last time I put my mouth
No be small see finish na'in make I dey own
I plaster wetin concern for people gist or people post
When e be say if u fit go close and see some shit
You go notice say na everybody life dey fuck , erigga talk
People for internet shift goal post
[Chorus]
Rest in peace to all the friendship when money spoil
As you dey ur own I dey my own you no get peace of mind?
Two tequila to relationship when money spoil
As you dey ur own I dey my own I come get peace of mind
Rest in peace to all the friendship when money spoil
As you dey ur own I dey my own you no get peace of mind?
Two tequila to relationship wey money spoil
As you dey ur own I dey my own I come get peace of mind
[Verse 2]
If I do good my guy na sand them go write am
But if I do bad na stone make e no wash comot
Who dey with lighter abeg I wan puff this backie
My chest full I gats blow some kind things commot
As I dey finish my show drop the mic dey go
Continue my kpo na airport na'in me dey face so
Tinted SUV, fans dey out dey scream
Wetin be just picture to you nah full human being dream
No be to scream on kolos I tell am say relax
Your brain no carry am my praying na to see u pass
This phase when you dey na juvenile delinquency
Try take am eazy next thing bouncer tell am shift
I know say for your mind you feel say erigga dey form
Because of common picture well na you look me common
So now she hates me anytime when she hear my songs
She go just off am go my page dey talk anyhow
No dey compare me, everybody get their path
No level na expectations break your heart
The business na temperature when hot observe
When you cold dem no go call nothing personal
[Chorus]
Rest in peace to all the friendship when money spoil
As you dey ur own I dey my own you no get peace of mind?
Two tequila to relationship when money spoil
As you dey ur own I dey my own I come get peace of mind
Rest in peace to all the friendship wey money spoil
As you dey ur own I dey my own you no get peace of mind?
Two tequila to relationship wey money spoil
As you dey ur own I dey my own I come get peace of mind
Written by: Erigha Agharivbie