Lyrics

[Verse 1]
I come this life around nine
First Igbo when I drag na around nine
Lost two of my best friends around nine
Na for chevron dem pronounce am dead around nine
First head when I get na around nine
My whole life don start to bend around nine
The only news we dey believe na around nine
NTA my mama don dey house around nine
He dey come the uncompleted building around nine
Before e jump two seconds we don surround nine
Be like film I wish you dey there around nine
Small children all of us go dey around nine
We don dey worry the community around nine
We don dey smoke sag go school around nine
Saturday no level jump the fence around nine
First handcuff dem put for my hand na around nine
[Chorus]
Hooo around nine
Oh around nine
Oh around nine
[Verse 2]
The first time I see magistrate na around nine
The next day I dey court case dey start around nine
The trauma no too much for me to see around nine
But no be big decision for pikin around nine
Fuck the world nobody love me so around nine
I don dey hustle market dey finish around nine
Without money I know how them treat me around nine
Na why I dey grind from morning till around nine
Dem kill my guy I wish he comot house around nine
E for still dey here but he kele say around nine
You fit dey come police no dey dey around nine
Area dey hot and I know say e dey with one nine
Funny enough I wrote motivation around nine
Coincidently this jam too na around nine
Sorry say I build this whole song around nine
E no go make sense if I no drop am around nine
I swear, kind of crazy things that happens around nine, right?
Around nine police don come with their hilux with full light
Dey spray bullet dey fall for zinc
Around nine mama no know where e pikin dey
Monkey tail back of church kele dey suck his stick
All this your wado wado I do am around nine
Who you feel say she dey talk to around nine
Put you on hold we book Uber around nine
X people go see story talk around nine
[Outro]
This little light at nine I’m gonna let it shine
Written by: Erigha Agharivbie, Great Adamz
instagramSharePathic_arrow_out