Lyrics

[Verse 1]
Na if you hear say I die, say person shoot me
Will you cry or say, "Na wetin my mouth put me?"
What if you hear say, "Na one robbery when I go?"
Cause, I don tire for underground, I just wan blow
Shoot videos wen bad, like them daddy yo
Put am for Trace, Hip TV and MTV yo
Oniru on Sunday, scatter G12 Bar
Enter Cotonou, go buy like 20m car
Na in those days this kind talents fit blow you
Nowadays, without money, nobody wan know you
Presenters want their share, even DJ too
100k each, which show these upcoming dey do?
Get the nerve say Erigga shoot with Clarence
Under this recession, how much dey the balance?
The industry for Nigeria be like campaign
Share the money, PDP, if you wan reign
E be like say na endorsement be the new swag
Even if money no follow, you fit take am brag
Label dey spend big money for artiste head
But the artist no dey go show, many artiste dead
Now for you too leave the label, be like like concrete work
Very hard, cos of wetin dem don spend on top
Cos your boss dey expect hundred million
After all this song blow, wey the hundred million
Now label don cast, e don go to G back
Word on the street, dem collect the house and Jeep back
Same girls when dey dance, when dey hear your beat
Na dey take you do yeye, when they hear your gist
[Chorus]
But, welcome to industry nite
Na you dem dey host today, you dey perform right?
For your mind, all these men wen dey here love you
But, when dey reach their house, na dem go judge you
Guy, welcome to industry nite
Na you dem dey host today, shey you go perform right?
For your mind, all these men wen come here love you
But when dey reach there various houses, dem go judge you
[Bridge]
I swear down mehn, the fake industry we have right here mehn
Fake likes, fake followers, fake views mehn
But any how shaa, l can't just leave you stranded
So l gat to bring in the real, you know what am saying?
[Verse 2]
A trip to the South, you no need visa
King of the South to your door, like Domino Pizza
The way my rap deep, I dey fear make you no drown
Won't stop, till my money long pass devil gown
A trip to the South EP, use your eyes listen
And mouth, look the talent the industry is missing
Rappers dey fear, dem no believe say I go blow one day
Heart dey beat anyhow like who follow one way
If na beef you dey find, I shade am like suya
Salam alaikum, my kala dey reply puya
Tell your producer, or, use him number text you
Say better beat dey, you come studio, we mess you
Na me naim own the throne, you just dey stone the throne
Na street carry am give me, I no fit bone the throne
My teacher tell me say, "Na army gun go shoot me die"
But instead, na Clearance na im dey shoot me, guy
The day anonymous call me, I dey jungle dey smoke
Sign contract, I never start, industry don dey smoke
I don big pass who dey write, na straight from my head
Commot your leg from wire, Warri say abeg
Written by: erhiga agariubie
instagramSharePathic_arrow_out