Lyrics

[Intro]
Abeg (How far?)
Boy come hear story oh (Wetin dey happen again?)
Who get money buy motor, who dey trek say he no like the colour
Wahala
Ọmọ, me when dey trek before I buy my small Benz oh, you say you no like am
Say na this one I need buy, wetin be your problem nah, you be witch?
[PreChorus]
Ta lo n pe mi?
Who dey call my name?
Dem say heaven and hell is real, I de try not to go astray
Ta lo n pe mi?
Lord I no want to die broke oh
I don too hustle, I no wan struggle underground again
So I say
[Chorus]
This year, oh Lord, say this year
As You do for me, do am for my guys, na family time
This year, oh Lord, say this year
As You do for me, do am for my guys, na family time
And na so e go be
[Verse 1]
Emeka papa waka jam me dey press e phone
Trenches pikin when never see Nokia before
E tone change, "Criminal, will you drop that phone?"
As e dey throw me cọmọt the house na with better konk
As I dey close the door, I dey tell myself
This money when dem get so, I go get am, I swear
Because, the chichiring don dey wan too much
Funny story, hin papa na our elder for church
You don dey house make money lost, make we say 1k
Two 5 and na the same thing dey your pocket
Nothing don lost for this house, especially money
Na when your guy come, search am, see embarrassment
I'm from the gutter, ask any ogoro you know
I dig gutter, sell ìgbó, for Ejebado
But no be story when we talk when we dey waka go farm
Nai we go put when we dey come back, Oluwa confirm the plan abeg
[Chorus]
This year, oh Lord, say this year
As You do for me, do am for my guys, na family time
This year, oh Lord, say this year
As You do for me, do am for my guys, na family time
And na so e go be
[Verse 2]
Nwanne m, ogogoro no be mmiri
Forget say e resemble water
Catarrh no go fit ever go with bread
Forget say e resemble butter
When I no be beans dirty
Why I go allow make dem count me out?
See bros when no show me way
E don dey beg, e wan dey bounce me now
If to say fish know say na water go cook am done
E for don discharge, na wahala God put am gan
Make God no allow us swim with enemies
People of this world say dem wicked gan
Before me and my guys come dey jọjọkịjọọjọọ
Wetin our eyes see, o pọ pọ pọ, o pọ pọ pọ
Ṣugbọn a a fọ fọ fọ
This year a lẹnu bi pọn pọn pọn
[PreChorus]
Ta lo n pe mi?
Who dey call my name?
Dem say heaven and hell is real, I de try not to go astray
Ta lo n pe mi?
Lord I no want to die broke oh
I don too hustle, I no wan struggle underground again
So I say
[Chorus]
This year, oh Lord, say this year
As You do for me, do am for my guys, na family time
This year, oh Lord, say this year
As You do for me, do am for my guys, na family time
And na so e go be
[Outro]
Baba God, abeg eh
Run am for this person when dey hear this music right now
E just on he JBL
Him and e guys, all of them dey together, run am for them too
Confirmation make e steady
Make B-T-C steady
Make the money dey come steady for everybody
Written by: erhiga agariubie
instagramSharePathic_arrow_out