Top Songs By Erigga
Similar Songs
Credits
PERFORMING ARTISTS
Erigga
Lead Vocals
Oga Network
Lead Vocals
COMPOSITION & LYRICS
erhiga agariubie
Songwriter
Oga Network
Songwriter
Lyrics
[Chorus]
Wahala dey
Wahala full here oh
Country wey blind man dey count money, wahala dey
Wahala dey
Wahala full here oh
Armed robber dey call thief ole oh, wahala dey
Oga DPO, na who thief e phone for inside police station?
NEPA office on generator, dem no know when light go come
[Verse 1]
As I dey follow you dey talk, all my men don off
The loud we dey smoke, you no fit drag am pass one puff
We tire for Nigeria matter, I no fit lie you
Na wetin Fela and Shana talk still dey happen
Who rule go waste money, work e no go do
Hustle don make boys forget wetin dem read for school
12 years, 13 years, don dey do yahoo
Dey look epa wey no dey do like big malu
Epa don graduate from Ekpoma but no level
He find work, he tire, he kuku join HK
According to am, the rain wey beat am today
Go wash 'im Benz tomorrow once he woman pay
All the women he dey jam, no one get shishi
I no fit judge the story long pass Deeper Life preaching
Since Jonah no get patience, he join taking
Na last week dem kpuff am close to that bakery
[Chorus]
Wahala dey
Wahala full here oh
Country wey blind man dey count money, wahala dey
Wahala dey
Wahala full here oh
Armed robber dey call thief ole oh, wahala dey
Oga DPO, na who thief e phone for inside police station?
NEPA office on generator, dem no know when light go come
[Verse 2]
Dear Abacha, small thing fit reach me?
The last one you send come, area no see shishi
Stay at home, but, where the electricity?
Nigeria na cruise, I swear, God forbid bad thing
Wetin dey occur, my WhatsApp na Mandilas?
View my status, na shoe, bag, hair and slippers
16 years no dey sleep house, she done enter street
Dey sell pussy for Lekki, her father can't say shit
Cos na she dey survive dem, alert steady
This generation done cast, when e go endy?
Na yahoo money make aunty collect big slap
From 17 years old boy, dem two dey my snap
Nigeria now be like fowl wey no get owner
Who swear give us, e no go better for una
Covid-19, graduate wey suppose give us cure
Don turn makeup artist, dey give director pure
[Chorus]
Wahala dey
Wahala full here oh
Country wey blind man dey count money, wahala dey
Wahala dey
Wahala full here oh
Armed robber dey call thief ole oh, wahala dey
Oga DPO, na who thief e phone for inside police station?
NEPA office on generator, dem no know when light go come
[Outro]
Wahala dey oh, wahala dey oh-oh-oh
See this country wey blind man dey count money oh-oh no
Wahala full everywhere brekete, brekete
Written by: Oga Network, erhiga agariubie