Top Songs By Erigga
Credits
PERFORMING ARTISTS
Erigga
Rap
Igosave
Vocals
Oga Network
Vocals
COMPOSITION & LYRICS
Evans Ifeanyibema
Songwriter
Anikwenze Echezona Valentine
Songwriter
Chech Mr Producer
Composer
Oga Network
Songwriter
erhiga agariubie
Songwriter
Lyrics
[Verse 1]
My mommy say, "My son, you know the devil"
If no be open eye, e for still dey for heaven
E no like number two, e want to high e level
But today, e no dey among them wey dey for heaven
Solution to problem no dey for bottle of beer
Sure say no be dream wey we dey for here?
You sure say one day person no go wake for there?
Because wetin I dey see, dey make me over fear
And this is not a story book
Teacher don teach you, like you learn, you like you look
But no go turn the fish when chop the worm swallow hook
Because when you go dey drag, na corner we go dey dey look
[Chorus]
If na only food wey dey make you come around (E no good oh)
If na only food wey dey make you come around (E no good oh)
If trouble dey, work dey, make you try dey come around
Make you show your neighbor love, cos e no good oh
If na only food wey dey make you come around, e no good oh
[Verse 2]
Abeg, yo
Why e be say na only when I post better thing
Nai you dey come around, say boss give me something (Ụfụrụkpe)
Screenshot your account dey send me
But when better money dey inside, you no dey send me (Greedy people)
Why e be say we no fit share update? (Why?)
Why e be say you don dey change of late? (Why?)
You no dey give unless say na babe
Na you no get, but na you still do giveaway
You say hi, I say hi, next thing na account
Senior man, your loyal girl dey here dey mount
After honorable don shift your pant
Why you no play my music for am, turn am to my fan?
So he fit dey help me the way e dey help you
But you no go ever gree, greedy girl, fuck you
Urgent 2k kill you there
You dare write me again, in fact, I don block you
[Chorus]
If na only food wey dey make you come around (E no good oh)
If na only food wey dey make you come around (E no good oh)
If trouble dey, work dey, make you try dey come around
Make you show your neighbor love, cos e no good oh
If na only food wey dey make you come around, e no good oh
[Verse 3]
Yeah, the last control you go, them give you 1 meter
You pocket am for knicker, you no tell Anita
You still come her house, come thief her hair
Wicked girl, no be you get 2 million there?
All this thing just remind me of my jazzman
I go e house for Ijebu, na my pastor I jam
E wan hide, I say no need, I understand
No be only you nai things dey hard
Na the day I do for you I be better person
The day I no do, "Leave am, na yeye person"
Before you ask, ask wetin you don do for me
Give man pass wetin e deserve, e go act funny
[Chorus]
If na only food wey dey make you come around (E no good oh)
If na only food wey dey make you come around (E no good oh)
If trouble dey, work dey, make you try dey come around
Make you show your neighbor love, cos e no good oh
If na only food wey dey make you come around, e no good oh
Written by: Anikwenze Echezona Valentine, Evans Ifeanyibema, erhiga agariubie