Top Songs By Oga Network
Credits
COMPOSITION & LYRICS
Evans Ifeanyibema
Songwriter
Lyrics
[Intro]
Rain wey fall for harmattan
Cassava suppose value am o
But monkey no wan know who plant banana
Na banana consign am o
[Verse 1]
Shey dem say if e reach mouth e go reach belle
Wetin come go dey vex belle when e reach mouth
Help me ask belle
I wan know wetin vex belle
Ahhhh ohoho haaaa
[Chorus]
Rain dey beat us
Sun dey beat us
Hand dey beat us
Government hold the thing wey go help us
Dem no dey give us
Human being and open eye
[Verse 2]
Hawk and fowl dey one market o
Dey buy things dey put for one basket o
Dey hug each other
Dey share blouse and skirt
For here I no know who be who
[Verse 3]
She tell her mama say she dey go fight for her right
Cus since dem born her government never treat her right
She no know say she go die that night
Because the order wey dem give na shoot on sight
[Verse 4]
Honorable minister who dey off my mic
Na all these kind talk una no dey like
Una love loyalist wey go lick una yansh
But deep down una know say all una regime na trash
[Verse 5]
Rain dey fall instead of umbrella you give me broom
Even the umbrella wey you give me na gone too soon
Money dey miss set up panel oko don dey faint
From the look of things devil go first una repent
[Verse 6]
How you go say the IG live wey I watch no real
But snake swallow millions make I believe abi?
But put am for your mind say this generation different
We just dey wait for the right time make una prepare
We dey come
[Chorus]
Rain dey beat us
Sun dey beat us
Hand dey beat us
Government hold the thing wey go help us
Dem no dey give us
Human being and open eye
Written by: Evans Ifeanyibema