Lyrics

[Intro]
Oga Network on this
Towncrier have come oh
Ehe-ehe, ehe-ehe eh-eh
[Verse 1]
Aeroplane think say him na bird, until airport close
No mosquito in heaven, na wetin dem tell me
No be say dem go, or they get person there oh
Na still hear they hear oh
E don tey when we learn out lesson, who teach us na street
E don tey when we know where flesh dey for head of fish
I no dey do for you (You)
I no come impress you (You)
Pressure from you, say na who be you? (You)
[Chorus]
I go dey jeje, jeje dey go, jeje
I go dey jeje, jeje dey go, jeje
Where need run, I run am
I go dey jeje, jeje dey go, jeje
Where need trek, I trek am
I go dey jeje, jeje dey go, jeje
[Verse 2]
Sugarcane don dey bitter for here oh
One thousand ways to become rich
Na traffic I buy am, na poor man Dey sell am
My friend's name is how to own a car
E don dey trek since dem born am
He still don't own a car
How to own a car no get car
No wan hurry talk am oh
You need take time hear am oh
Cos if heavy rain fall
Ground go must feel am oh
[Chorus]
I go dey jeje, jeje dey go, jeje
I go dey jeje, jeje dey go, jeje
Where need run, I run am
I go dey jeje, jeje dey go, jeje
Where need trek, I trek am
I go dey jeje, jeje dey go, jeje
Written by: Evans Ifeanyibema
instagramSharePathic_arrow_out