Similar Songs
Credits
PERFORMING ARTISTS
Graham D
Performer
COMPOSITION & LYRICS
Nzeh Graham Onyemike
Songwriter
Lyrics
[Intro]
Graham D, na him do the beat
It's Graham D D D D D, Baba
It's Graham D, yo oh oh
[Verse 1]
E get one girl oh, she dey stay with her mother
On a faithful day, she wants to travel, na so her mother begin dey bother
She come ask her mama say, "Mama, what is the matter?"
Her mama say body dey do am one kind, say the journey fit get wahala
She come laugh laugh and tell her mama say na old age oh
Na old age oh, koko oh ehe
Mama say okay (Okay)
The other friends dem show (Ehe)
Mama start to pray oh (To pray oh)
Na so dem the look am go
Her mama tell them say as una dey go make Jesus Christ follow una
Holy ghost fire go follow una
Holy spirit go follow una
They begin dey laugh oh
Them say mama no space oh (Chei, no space, no space)
Like play, dem say no space for the car
Say mama no space for Holy Spirit
No space for Jesus Christ
No space for Holy Ghost fire
But there is space in the boot where the eggs and glass and drinks dey
And wine to pop champagne later ye, iyo koko
Na so dem tell Jesus Christ to enter boot
Na so, na so dem dey drive for road dey go, iyoko ịgbamgbamgbam
Na so them get accident, gbagam
Everybody die oh
But eggs and glass for boot no break oh
[Chorus]
See
Try believe oh
Try believe oh
Try believe in God
Even though you no dey go for church oh
Try believe oh
Try believe in God
Na only God fit save your life, my bother
[Refrain]
Ya mawa oh (Ya mawa oh)
Ya mawa oh (Ya mawa oh)
Ya mawa oh (Ya mawa oh, believe in God, ya mama oh)
Ya mawa oh (Ya mawa oh)
Ya mawa oh (Ya mawa oh)
Ya mawa oh (Ya mawa oh)
So believe
[Verse 2]
Na so them call am mama
Kasala don burst
Your daughter she don kpeme oh
Come identify the body oh
Na so mama dey run, dey run, dey cry, dey run, dey run dey come
When mama reach there, na so she see dead body surplus
With the car scatter
Na so she see her daughter
With her friends dead for ground but nothing for the boot scatter
They come dey wonder wonder why
Nothing for boot scatter (Why?)
The mama say she know
She say when she dey pray for them
Make Holy Ghost fire follow them
Make Jesus Christ follow them
Them say no space oh
Make Jesus Christ dey for boot oh
Na so Jesus Christ dey for boot
And save the eggs and drinks and glass, oh brother oh
[Chorus]
Try believe oh (Oh try)
Try believe oh
Try believe in God
Na only God oh
Even though you no dey go for church oh
Try believe oh
Try believe in God oh
Na only only God fit run am
[Refrain]
Ya mawa oh (Ya mawa oh)
Ya mawa oh (Ya mawa oh)
Ya mawa oh (Ya mawa oh, believe in God, mawa oh)
Ya mawa oh (Ya mawa oh)
Ya mawa oh (Ya mawa oh)
Ya mawa oh wewe (Ya mawa oh)
So believe
[Outro]
Wicked mix
Na only God na him fit do am
No matter what you do
Put God first
My name is Graham D
Written by: Nzeh Graham Onyemike