Featured In
Top Songs By Tony Tetuila
Similar Songs
Credits
PERFORMING ARTISTS
Tony Tetuila
Performer
COMPOSITION & LYRICS
Tony Tetuila
Songwriter
Lyrics
You don hit my car (Oyibo repete)
As you don bash my car (Gbese repete)
Tell me, you don hit my car (Oyibo repete)
As you don bash my car (Gbese repete)
Wetin you dey find, where you dey go?
As I dey waka dey go like so
Me, I am looking for this paddy
This paddy owe me plenty money
They tell me say en dey Ikoyi
Me, I get gidis for one party
Seri paddy yen, ofe pa mi?
Today na today, no time for story
Tinba dele re, Ti n gba mu
He must pay me all the money
I come reach him house, I come see say
People gather, dey just dey cry
I try to know wetin 'cause the cry
Dem tell me say my paddy don kpai
As I con dey go back to my house
I come meet small hold up for road
The next thing wey I hear, for my back
Na one scratch from another car
Eh! Eh! You don hit my car (Oyibo repete)
As you don bash my car (Gbese repete)
Tell me, you don hit my car oh (Oyibo repete)
As you don bash my car (Gbese repete)
See me, see trouble, oh, another gbese
Dead body no dey pay person money
Another paddy don dey bash my car
Today na today, no time for story
Ah! Eedris, na you? See wahala
Hey you, what's up, Tony, what's up, man?
E be long time, wey no see, what's up man?
Oh boy, stop that yarn o, wetin be what's up?
You bash my car, you dey tell me say what's up
Shey na what's up I go use spray my car?
Abeg pay me my money nah, which one you de talk sef?
Police con come, come dey measure the line
They say make I no worry, everything go be fine
They con the papers say I make sign
I sign my own, Eedris sign he own
I con dey wonder who get the fault
They say na my paddy get the fault oh
I pack my car, see trouble
Yanga dey sleep, trouble come wake am
Heh, heh, you don hit my car (Oyibo repete)
As you don bash my car (Gbese repete)
Tell me, you don hit my car oh (Oyibo repete)
As you don bash my car (Gbese repete)
Somebody oh, someone wey
You don kissie Mimi, bobo kolo
Shey na jigirijigiri we go take repair the car?
Shey, it good?
Somebody wey well, bobo kolo fit kolo
Begin dey drive car kai, kai
Don kolo, don girigiri
Palava hard to carry for head
Money no dey pocket for man to spend
One of my paddy wey dey owe me money
I reach im house, they say he don kpai
Another one don dey bash my car
Wetin I go do, e no get money
I come think say this stress no worth am
Today na your own, tomorrow fit be my own
I con tell my paddy, make he come dey go
Then I try to push my car from road
As I push am small, wetin I see
Na government car come bash my car
Again?
You don hit my car (Oyibo repete)
As you don bash my car (Gbese repete)
Tinubu, you don hit my car (Oyibo repete)
My own don better oh (Owo repete)
You don hit my car (Oyibo repete)
My own don better oh (Owo repete)
Tinubu, you don hit my car (Oyibo repete)
My own don better oh (Owo repete)
Tinubu, you don hit my car (Oyibo repete)
My own don better oh (Owo repete)
Tinubu, you don hit my car (Oyibo repete)
Written by: Tony Taquila