album cover
Stop B4 U Stop
150
Afro-Pop
Stop B4 U Stop was released on October 23, 2025 by Whodemborn_records as a part of the album Stop B4 U Stop - Single
album cover
Release DateOctober 23, 2025
LabelWhodemborn_records
LanguageEnglish
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM93

Music Video

Music Video

Credits

PERFORMING ARTISTS
Readwon
Readwon
Performer
hipopotunez
hipopotunez
12-String Acoustic Guitar
COMPOSITION & LYRICS
OYEKUNLE RIDWAN OLUWATOBI
OYEKUNLE RIDWAN OLUWATOBI
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
hipopotunez
hipopotunez
Producer

Lyrics

Hipopo!
No go kill yourself o, my padi
E get many ways, wey you fit faji
Ahh
Colos no be big boy
Gas, ice
No be big boy
stop Colos before Colos stop you.
stop Colos before Colos stop you.
Hun
stop Colos before Colos stop you.
E bami so fun won
E je a ma so fun won
stop Colos before Colos stop you.
Eba mi so fun won
E bami so fun won
First, colos na the cheapest way to die
Cos no be plant, na synthetic, I tell you guy
Colos get the power to take over your mind
And If you lose control of that, you no be man walai.
You go de hear when dem say, are you out of mind?
Your mind no Dey here wey teacher Dey talk, e get why.
If you wan do something, dem go tell you put am for mind
Anything wey fit off that mind no good for you my guy
Stop colos before Colos stop stop you.
Na you go fit help yourself nobody go disturb you.
If you say No, nobody fit chook am for your mouth
Ice go make you stay far away from real people wey love you.
Na people wey no worth am, you Dey try dey impress
But the truth be say if you tell them No, dem go Vex
Your biggest enemy, na that one wey Dey for your head
Na hein Dey tell you, it’s hard to stop, I’m trying my best.
Your breath na consciousness no de mix poison with am,
Na breath dem talk say GOd take create the first human
Your system no like am, e go shut down, you go sleep off.
You go lost am but when you wake, you go find am, you go still puff.
Just to sleep again, and you’ll keep repeating that,
if e never finish like this, you no fit comot inside
Food keh, Sheybi na who dey awake go chop
If you see money for food seff, you go reason Colos join.
You go de procrastinate better things wey you wan do
If you puff Colos for morning, no worry that day is gone too
You go break your phone, & you no know how e take happen.
You no go bath or change clothes, Colos go de give you joy too
Before you realize, all your better friends don leave you.
You attract what you are, na junkies go de meet you.
You no fit de chop these things na make you de plan better things
If dem ask about your plans, you go Dey tell them later things.
No go kill yourself o, my padi
E get many ways, wey you fit faji
Ahh
Colos no be big boy
Gas, ice
No be big boy
stop Colos before Colos stop you.
E bami so fun won
E je a ma so fun won
stop Colos before Colos stop you.
Eba mi so fun won
E bami so fun won
Every man get purpose but with these things, You no fit get.
You go know say you dey mess up but you no go fit regret.
Cos after one puff, na all your flaws you go forget
And e Dey kill, Imagine say 1k drug comot you for earth.
You don smoke reach where you Dey feel people presence
For your room, like say you Dey chill out with your friends
Una go Dey talk but na only you go Dey hear them
Anybody wey see you that moment go say you don de ment
And once people don Dey give you that kind tag
Enu lebo, no phor, if you no stop you go soon mad.
E go make you lose your job and you no go bother
You go sell your property just to puff, ko de da brother.
If you go like stop, first be say you go decide
If you don decide, then you go stay on am like that
Forget withdraw symptoms, that shit is not even real.
Stop thinking about it, to forget no go take two weeks.
Break out from drug abuse, you no need peace talk
I no dey on anything as I de record this song
But I fit dey act am, highness is already in you
Na you go just tap am, you no need anything new.
To join your system, God don complete everything
If you wan show person craze, my guy you no need anything.
Colos fit end you, I no de lie on God
Technically seff, Na weak man Dey rely on drugs
Stop Colos before Colos stop you.
Emi noni
Emi Idan whodemborn?
Say no to drug abuse
Hipopo!
Written by: OYEKUNLE RIDWAN OLUWATOBI
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...