album cover
First Gate
11
Hip-Hop/Rap
First Gate was released on July 11, 2025 by TGW as a part of the album First Gate - Single
album cover
Release DateJuly 11, 2025
LabelTGW
LanguageEnglish
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM74

Credits

PERFORMING ARTISTS
Wanle
Wanle
Background Vocals
COMPOSITION & LYRICS
Ogunlayi Temitope
Ogunlayi Temitope
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Wanle
Wanle
Producer

Lyrics

At your own risk make you believe this Wordplay
At the same time no carry the word play
Many things happen inside first gate
Wanle Je
E get one guy wey them dey call Idan Inside firstgate
If you see am omo you go call grace
He get rabba for hand girls dey call am Hot cake
Tall babes,short,fat,slim Hot babes
Idan get matter with them egbon adugbo one day
Naso them burst everywhere make them carry am come base
Them drop Chase,run 144ks
As the money drop naso Idan gbes
We hear say Idan dey do am e don tey
Now Idan do am go the wrong place
Words says everyday for the thief
One day for the owner
Owner no go joke with One Day
Wonni oti fo cup Wonni oti fo plates
Before he 4kup he did many foreplay
Chop chase pick race omo see craze
Awon eruku ti binu won tifo 46 crates
Everybody just dey para asking where Idan dey
All him friends wey sabi wettin sup don gbes
The ones wey lose guard omo I swear they don late
For broad day them carry AK begin busrt brain
Street is very dark man you gon learn don't play
Eni ori yo run race,If you price you gon pay
Many soul waste
It is called game
Wonni Ki sobia to degbo akesi oluganbe
Police no fit show face them talk say na cult case
Person wey die don die omo no Court case
Fvcksake
Them show face and still no case? okay
Abi if them ask you you fit talk say you know face
The matter long them still Dey fight after 4 days
That was on Monday to Thursday
Everybody no fit commot for hostel them frustrate
Everybody begin complain... Omo
How Idan take commot for street I no fit explain
Make them no go talk say na me explain wettin I no fit explain
Many things happen inside firstgate
I fit tell you more later but for now just dey
Written by: Ogunlayi Temitope
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...