Top Songs By Strapp
Credits
PERFORMING ARTISTS
Strapp
Performer
COMPOSITION & LYRICS
Ndumanya Uchechukwu
Songwriter
Lyrics
The one on the beat
Urhn, it's the one on the beat
yeah, it's your boy strapp
many questions dey my mind
yeah, yo!
If na for beat you go see say the one dey legit
why did mike pass on before this is it?
we all wanna win, why do some taste defeat?
i no fit rap but why play my song on repeat?
why efcc dey choose person dem go arrest?
why are some people scared of the hiv test?
hahaha
why can't you and i just live in peace?
why wait until we die then we rest in peace?
why they lie say police bail na free?
why call it freetown when nothing in the city is free?
why e dey easy to fall than for person to rise?
death is part of life so why cry when somebody dies?
why time dey move slow when things dey go bad?
why dem they point fingers like dem no dey do bad?
why person wey you love go still break your heart?
why are you scared to start?
why things fall apart?
why?
Just leave me alone
why is it that most people ain't pleased
so we really gat to know
after all you give em, just for granted, we were driven
o why? why? why?
o no, whyyyyyy? whyyyyyy?
why?
Why common sense no dey common?
why nepa still dey take light later person bulb go come on?
why dey talk say ibo too like money?
why hard work no determine person wey go get plenty money?
why adam sef chop that fruit?
why some babes no dey like good guys wey dey tell them the truth?
why they talk say mungo park discover river niger?
why they talk say columbus discover america?
why gowon dishonor aburi accord?
why for street honda vehicles no dey move in one accord?
why palliative for we masses dem go hide am for store?
we get too many resources, why the masses dey poor?
why so many religion but the same devil?
why i no dey fear police cos their own na settle
i speak my dialect for school, why call it vernacular?
why godly songs no dey too blow compared to secular?
why?
Just leave me alone
why is it that most people ain't pleased
so we really gat to know
after all you give em, just for granted, we were driven
o why? (why) why? why?
o no, (why) whyyyyyy? whyyyyyy?
why?
Why nigeria still dependent after independence?
why protest for this country don become an offense?
why they talk say education is the key to success?
why nobody go follow you unless they see you progress?
why 9ice no win the grammy upon say i no doubt?
why person wey no be anything go just dey make mouth?
why humpty dumpty head no be sign of wisdom?
ordinary herdsmen, why dem they carry gun?
(oh no)
why betrayal always come from person wey we call friend?
why most nigerian movie you fit predict the end?
why to borrow money easy but to pay back dey hard?
for protection pray to God, why you dey use bodyguard?
black is so beautiful, why person still dey bleach?
nigerian civil war, why for school dem no teach?
even when i don forgive, why you tell me forget?
why forget an event? when i still dey regret
why?
why?
why is it that most people ain't pleased
so we really gat to know (why)
after all you give em, just for granted, we were driven
o why? (why) why? why?
o no, whyyyyyy? whyyyyyy?
why?
Bank alert mix
Written by: Ndumanya Uchechukwu