album cover
Overspeed
6
Music
Overspeed was released on May 24, 2024 by Dvpper Digital as a part of the album Prince Of The Ocean
album cover
Release DateMay 24, 2024
LabelDvpper Digital
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM89

Credits

PERFORMING ARTISTS
Okezzy
Okezzy
Performer
COMPOSITION & LYRICS
Eze Destiny Okechukwu
Eze Destiny Okechukwu
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Corekt sound
Corekt sound
Producer

Lyrics

E be the beat okezzy
Ha!
Buhmenoya
Ha ha ha ha ouw
Ha ha ha ha ouw
Ha ha ha ha ouw
Ha ha ha ha ouw
International African boy wey Dey vibe ooh
Huncey Bankz
Chibuzor nah my paddy from way back
To get admission go school nah him dey pray pass
Finally, him name come out second list
Nah so momsy come dey run around to afford school fees
Second semester resume everywhere dun level
Chibuzor sabi book for assignment people dey settle
But e be like say nah only him dey use android
Some of him men dey on iphone 11
 Eeh
Wetin dey play baba show me the way nah
Nah so them chibuzor to register HK eh
Like play play e no tey chibuzor dun dey collect the least 1k
Everywhere dun good, money dun dey chibuzor dun forget where them dey sell OK
When him dey ball, e dey ball like Torres
Yu go no say this one dun collect eeeh
The things you dey see my chally
 No be the way e be
This akara wey you see like this get a lot of beans
Use your head
Make you fit to grind your beans ou
If I tell you Wetin Dey agidi my guy you nor go believe ooh
Overspeed dey kill
Overspeed dey kill
Over taking is allowed ou
Them nor go hear say your fuel dey leak
Overspeed e dey kill oow
Overspeed e dey kill oow
Overtaking is allowed oow
Them nor go hear say your fuel dey leak oou
    Verse 2
  E no tey chibuzor man dun go buy G-wagon and no be say the boy even carry begum
This kind block nah for people wey dey work for sight
Chibuzor even follow tear nylon
Wetin dey sup baba, wetin dey sup
Those people wey dey carry this block wetin dem chop
Nah so chibuzor go meet him man IK
Baba, put me through nah give me update
IK tell chibuzor say matter long
Yu sure say yu fit do anything wey baba talk
Chibuzor say no shaking me I ready come
Eh! Yu sure yu ready no be carry talk
Chibuzor say no worry I full ground if nah lion mouth I see the money I go choke hand
E no tey IK and chibuzor lap baba
Baba tell chibuzor say e go sacrifice mama
Chibuzor say no o say make them shun matter
Yu dun come be say yu dun come we no fit shun matter
We dey give you 3days make yu run and if 3days pass chibuzor yu go run mad
1day 2days 3days where chibuzor dey nobody know
Well somebody just call me say them see chibuzor for rumuokoro nah so the story go
The things you dey see my chally
 No be the way e be
This akara wey you see like this get a lot of beans
Use your head
Make you fit to grind your beans ou
If I tell you Wetin Dey agidi my guy you nor go believe ooh
Overspeed dey kill
Overspeed dey kill
Over taking is allowed ou
Them nor go hear say your fuel dey leak
Overspeed e dey kill oow
Overspeed e dey kill oow
Overtaking is allowed oow
Them nor go hear say your fuel dey leak oou
Written by: Eze Destiny Okechukwu
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...