Credits
PERFORMING ARTISTS
2Baba
Performer
Falz
Performer
COMPOSITION & LYRICS
Innocent "2Baba" Idibia
Songwriter
Folarin Falz Falana
Songwriter
Efe Omorogbe
Songwriter
Cobhams Asuquo
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Cobhams Asuquo
Producer
Lyrics
[Verse 1]
Hmm hmm
Ladies and gentlemen
Introducing extra special 2Baba
And honorable Falz D Bad Guy
Bad guyzes in the building yeah
Honourable
[Verse 2]
As gbege dey happen, around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dampen
So my guy na your eyes you go sharpen (Honourable)
You need to take of yourself
Cos the curve go flatten
Better go dey start to dey happen
[Verse 3]
Know say, gbege go come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We must to rise up again eh
Gbege must come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We go rise up again (Bad guyzes in the building yeah)
[Verse 4]
Yawa dey today but hey morrow go better
Gbege wey dey now e no go kill us, never
I collect one trophy make I take forget am
2 bottles with 2baba we dey 4gether (A guy)
Make I keep am short o mi o fe soro ju
Everybody know say all my people dem dey colorful
When the gbege jam us for body we lost one or two
And d matter hook us for neck we no no what to do
Stop there, turn round you go see action
Where man fall down, he go still rise up
Weytin no kill man na weytin make him sharp nah
And you no fit die for your film na you be actor
You go wide the chest like you be man o' war
You go wipe the debt like you be janitor
You recharge the energy and start afresh
Whether you dey Budapest, Lagos city, Marrakech
[Verse 5]
As gbege dey happen around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dampen
So my guy na your eyes you go sharpen
(My guy na your eye you go sharpen)
You need to take of yourself
Cos the curve go flatten
Better go dey start to dey happen
[Verse 6]
Know say, gbege go come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We must to rise up again eh (Extra special, extra special)
Gbege must come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We would rise up again o
Ah, the thing e just wan
[Verse 7]
Yeah, the pepper go still rest, e go still rest ceteris paribus
Better go still come wey flexing go dey unanimous
All of my people turn dey turn up till maximum
Bad water wey dey flow come no fit carry us
As I dey talk am so n gbo? sho gba mi gbo
All the kwanta wey you think say kole pari mo
Sofun tolani, chidera pelu amina
Pe adura wa tigba ka ma s'amin mo
To the heroes we lost, we no go forget (Never ever)
Heaven prepare the medal wey dem go collect (Extra special)
Our black panther don unite for black mamba
When the time come, we go still jam for wakanda
When you get up help us halla captain chika
And god bless the soul of uwa and tina
The time tough but no matter how e rough
Bad water wey dey flow come e no fit carry us
[Verse 8]
As gbege dey happen around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dampen
So my guy na your eyes you go sharpen
(Sharpen your eye, my guy, walahi)
You need to take of yourself
Cos the curve go flatten
Better go dey start to dey happen
[Verse 9]
Know say, gbege go come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We must to rise up again eh
Gbege must come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We go rise up again o
[Verse 10]
Ah, this thing just wan test every man
The same thing dey happen inside inna every land
E no be competition
This one no concern politician
E just wan test the man
Same thing dey happen for every land o
This no be competition
This one no concern politi-
[Verse 11]
As gbege dey happen around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dampen
So my guy na your eyes you go sharpen
(You need to sharpen your eye)
You need to take of yourself
Cos the curve go flatten
Better go dey start to dey happen
[Verse 12]
Know say, gbege go come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We must to rise up again eh
Gbege must come and go
Ebelebe, we suppose to jump am o
Ebelebe, you suppose to know say
We go rise up again o
Written by: Cobhams Asuquo, Efe Omorogbe, Folarin Falz Falana, Innocent "2Baba" Idibia