Lyrics

Keep it lowkey till you are sure of it Plenty people no like you my gee Them just dey your side just incase you succeed So be careful I no post for IG no mean say the doings no dey happen Focused on my grind,I don't bother with these people If you succeed them go full Ground,when you fall them go just leave you Them dey clap for you no mean say them dey happy Be careful of the people wey dey tell you say them get your back Because na them go fit backstab you Love everybody but trust no man Even Jesus was betrayed by his own disciple At the same time,pay attention to those that love you Those people wey dey your side when you no get one kobo Those that believed in you when you didn't believe yourself Those that held you down when there was nobody there When the crowd come no forget them Because na them go still dey when there's no one else Yeah Shout out to my guys wey dey grind One day e go pay,abeg no go loose hope Everyday for the thief but one day for the hustle If you fall,you go stand If you give up na you loose oh You promise mama house,you go like give popsi Benz So why you want come give up now,shebi you dae ment Focus on the hustle,I know say e no easy But you go look back one day come happy say you no quit And if e later sure for you,no go carry body Avoid all these girls,na billing full their body That iphone you want give Amaka,you fit give am momsi She go appreciate,na she pray make you succeed And to the guys wey dey look another brother pocket You dey ask why e no be you wey make am instead If na you wey get that brother load,you fit no carry am So why you come dey envy am Your brother man cash out,you dey show am attitude When you suppose happy,e mean say line dey move Who first blow no matter,as long as we all make am The fight na against poverty,e no bad if we all make am Life no get gaurantee,free your mind from hate Spend time with the people you love, tomorrow fit late As you dae hustle try dey enjoy Problem no dey finish Brother man, problem no dey finish Why you think say I no look like wetin I dey pass through Situation no go last forever Take some time to catch cruise Many of your mates don die,be grateful If you die people go move on Dead body no dae hustle Listen to my words,I no come here make I rap Na wisdom I dey give Lifeline in every bar So when you listen to this song,I hope you get inspired Yeah I hope you get inspired
Writer(s): Excel Ngalome Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out