Top Songs By African China
Similar Songs
Credits
PERFORMING ARTISTS
African China
Performer
COMPOSITION & LYRICS
ONUOHA TIMOTHY CHINAGOROM
Songwriter
Lyrics
[Verse 1]
Food e no dey
Brother eh, water no dey
And our country no good o, everyday for thief one day for owner e
Poor man wey thief maggi ọmọ, dem go show him face for crime fighter (Crime fighter)
Rich man wey thief money ọmọ, we no dey see their face for crime fighter
Tell me something I don't know
[Verse 2]
Rich man go dey halla prayer (Mo dupẹ)
Poor man go dey shout (Anwuola me e)
Rich man go dey halla prayer (Mo dupẹ)
Poor man go dey shout (Anwuola me e)
[PreChorus]
Make una lead us well
No let this nation to fall inside well
[Chorus]
Mr. President, lead us well
If you be governor, govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
O ya lead us well (Nne me e)
Govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
[Verse 3]
Fuel e no dey
Brother eh, transportation no dey
And our road e no good o
What about the NEPA people o, we no get light
Everybody just dey halla
Fuel no dey, na how we wan survive
Many youth ready for work
But as work no dey, na how dey wan survive
We be giant of Africa
But to get visa enter Ghana na WAEC
My God, policeman go see white
E go tell you say, I say that thing na red

[Verse 4]
Alhaji wey pull khaki say the name of him party
People destroying people na the name of the party
Election for my country na paddy paddy
Wayo, wayo
Arrange naa ni
People wey vote them in still dey live in pain
This na disgrace, I am so ashamed
Me don collect shop permit, collect trading permit
Raiding permit, you still dey burn shop
You wan tell me say you no know when them pay
Why you dey make us dey live in pain
[PreChorus]
Make una lead us well
No let this nation to fall inside well
[Chorus]
Mr. President, lead us well
If you be governor, govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
O ya lead us well (Nne me e)
Govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
[Bridge]
Ọmọ nothing dey pa
Anything wey pa na witch
And make we dey say ọmọ no lele
Tanke
[Verse 5]
Food e no dey
Brother eh, water no dey
And our country no good o, everyday for thief one day for owner e
Poor man wey thief maggi ọmọ, dem go show him face for crime fighter (Crime fighter)
Rich man wey thief money ọmọ, we no dey see their face for crime fighter
Tell me something I don't know
[Verse 6]
Why rich man go dey halla prayer (Mo dupẹ)
Poor man go dey shout (Anwuola me e)
Rich man go dey halla prayer (Mo dupẹ)
Poor man go dey shout (Anwuola me e)
[PreChorus]
Make una lead us well
No let this nation to fall inside well
[Chorus]
Mr. President, lead us well
If you be governor, govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
O ya lead us well (Nne me e)
Govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
[Verse 7]
Fuel e no dey
Brother eh, transportation no dey
And our road e no good o
What about the NEPA people o, we no get light
Everybody just dey halla
Fuel no dey, na how we wan survive
My God, many youth ready for work
But as work no dey, na how dey wan survive
We be giant of Africa
But to get visa enter Ghana na WAEC
My God, policeman go see white
E go tell you say, I say that thing na red
Tell me something I don't know
[PreChorus]
Make una lead us well
No let this nation to fall inside well
[Chorus]
Mr. President, lead us well
If you be governor, govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
O ya lead us well (Nne me e)
Govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
[Chorus]
O ya lead us well (Nne me e)
Govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
[Chorus]
O ya lead us well (Nne me e)
Govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
[Chorus]
O ya lead us well (Nne me e)
Govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
[Chorus]
O ya lead us well (Nne me e)
Govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
[Chorus]
O ya lead us well (Nne me e)
Govern us well
If you be senator, senate am well
If you be police, police well well, no dey take bribe
Written by: ONUOHA TIMOTHY CHINAGOROM