Lyrics

Trybe Records 2Shotz Trybe Productions ELDee The Don When I dey primary five (eh-ehn?) I get one friend He no dey to dey class, he no just send You see, Emeka no know book but For class everybody dey wonder how him take dey pass (ole) One day we get lecture wey Emeka dey there Him just dey concentrate like say him mind dey there For where, na gimmicks, make we take no fear The boy just dey stratеgies some skills and ideas You don see with your two еyes dey offload your hand bag Wey person for hand con dey find your school bag Dey follow you dey argue, on top am dey brag Ah-ahn na, your own no get label for the tag Shut up my friend, how you take know? If I finish with you, na your blood go dey flow Bros abeg na, abeg no be so In fact when I take the bag I no know Thief my guy bag talk say him no know Thief, ole, carry am go He say na him first time, abi no be so? Thief, ole, carry am go When you hear "bring tyre", your eyes come clear Thief, ole, carry am go Carry gun, carry knife, only you, you no dey fear? Thief, ole, carry am go See this man sef, see you kack for office You dey form oga, while your people them dey hiss Na pen you dey take do magical tricks You no dey touch money, but money go dey miss (ole) Your five account them don full for Swiss You dey chop, and you think say them no go notice Wetin you dey do bad, and you know this You see, I am smart, and you are a novice Na true you talk, but na thief be your work When you hear "bring tyre", make you no shock Your job na with tie and corporate knocks Agbada or kaftan, aso and rock Na this wan we dey call thief with style Chop alone and close the file Everyday empty promises go dey pile It is not my fault my brother, but meanwhile Embezzled money talk say him no know Thief, ole, carry am go You say na your first time, abi no be so? Thief, ole, carry am go When you hear "bring tyre", your eyes come clear Thief, ole, carry am go Carry pen add digits, only you, you no dey fear? Thief, ole, carry am go Your song never comot but e don dey Alaba As you sing finish them go carry am waka E go con plenty like cloths for Yaba E don dey go platinum, but my pocket is flatter Na my own sweat them dey use make dough See, this MC's thief my flow Put my life-saving con carry am go Bring tyre, fuel, matches, oh no Pirate my CD talk say him no know Thief, ole, carry am go You say na your first time, abi no be so? Thief, ole, carry am go When you hear "bring tyre", your eyes come clear Thief, ole, carry am go Ten thousand copies only you, you no dey fear? Thief, ole, carry am go Carry am go Thief, ole, carry am go (ole) Carry am go Thief, ole, carry am (ole) Bring tire, carry am go Thief, ole, carry am go Ten thousand copies only you, you no dey fear? Thief, ole, carry am go Ole, ajibole Ole, ajibole Ole (onyoshi leya), ajibole Ole (onyoshi leya), ajibole Ole (onyoshi leya), ajibole (onyoshi leya) Ole (onyoshi leya), ajibole (onyoshi leya) Ole (onyoshi leya), ajibole (onyoshi leya) Ole (onyoshi leya), ajibole Let's dance
Writer(s): Sikirullahi Dabiri Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out